13 December 2021

India Harnaaz Sandhu don win Miss Universe 2021.
While Paraguay Nadia Ferreira be runner up and South Africa contestant Lalela Mswane place third as second runner up.
Di 70th edition of di pageant, hapun on December 12, 2021 for di Universe Dome for Eilat, Israel.
Di outgoing queen, Andrea Meza of Mexico crown Harnaaz Sandhu of India as her successor at di end of di event.
Eighty contestants na im compete for dis year pageant, including di first-ever entry from di Kingdom of Bahrain.
Top ten dis year
See di contestants wey make am to top ten dis year.
- Thessaly Zimmerman (Aruba),
- Valeria Ayos (Colombia),
- Clémence Botino (France),
- Harnaaz Sandhu (India),
- Nadia Ferreira (Paraguay),
- Beatrice Gomez (Philippines),
- Michelle Colón (Puerto Rico),
- Lalela Mswane (South Africa),
- Chantel O'Brian (Bahamas)
- Elle Smith (United States).
Profile of Harnaaz Kaur Sandhu

"Faith na wetin you no fit see. Na something you dey feel. Na di feeling wey I get for my heart today. I get faith in God, my family and di blessings don shower on me. I don enjoy my journey and as near di end of dis beautiful pageant, I wan remember di memories I get wit my family, my Punjab. I want make all of una know say I dey grateful for each and every one of you and for all di experiences I get in dis 1.5 months. I be winner already."
Dis na di last post Harnaaz Kaur Sandhu share for her Instagram page few hours before she dey crowned as Miss Universe 2021.
Di 21 year old wey win Miss Universe 2021 come from Punjabi and she represent Indian for di 70th Miss Universe Pageantry wey hold for Eilat, Israel.
Harnaaz Kaur Sandhu na Punjabi model and beauty pageant.
Dem born her on March 3rd 1999, for Guruharsahai to one Panjabi Sikh family.
Sandhu attend Kalia Public School and di Post Graduate Government College for Girls. She sabi speak Punjabi, Hindi and English well-well.
Di beauty queen start her pageantry journey wen she be teenager and don win ogbonge titles like Miss Ferozepur 2017 and Miss Max Emerging Star India 2018.
On 16 August 2021, Sandhu dey shortlisted as one of di Top 50 semi-finalists of Miss Diva 2021.

South Africa controversial attendance
Miss Universe competition na one of di largest and most recognised beauty contest for di world.
But Miss Lalela Mswane wey be Miss South Africa 2021 representative journey to contest for Israel, come with some controversy wey even become hot gist for social media.
Dis na afta South African goment say dem no get hand for her participation for di Miss Universal contest.
For inside statement wey di goment issue, goment say dem withdraw dia support for her to represent di kontri for di Miss Universal pageant contest for Israel.
Di goment withdrawal dey come afta calls for Mswane to boycott di pageant.
Those wey dey against South Africa participation for di contest dey protest against Israel alleged atrocities against Palestinians.
South Africans say dem sabi well-well di politics of apartheid and therefore no dey in support of wetin dey go on for Israel.
Tori be say South Africa get long standing for Palestinian independence.
And di rainbow nation African Union decision to grant Israel observer status for July 2020.
Di decision from di department of Sports, Arts and Culture bin dey backed by several political parties, and Mandla Mandela, di grandson of Struggle icon Nelson Mandela.
Who be Lalela Mswane?
Lalela Mswane na South African model and beauty pageant title holder wey dem crown Miss South Africa 2021.
Dem born her for 27 March 1997.
Dem born her for Richards Bay for KwaZulu-Natal province of South Africa.
Her papa, Muntu Mswane, na Eswatini-born former diplomat and minister wey die for 2010, while her mother Hleliselwe bin work as account clerk and homemaker.
She be di youngest of three children.
Afta she complete her secondary education for Pro Arte Alphen Park for 2015, Mswane enrol for di University of Pretoria, she later graduate wit Bachelor of Laws degree.
Before she become Miss South Africa, Mswane work as professional model.
ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmraeinnp2hZVraWlxaA%3D%3D